Wetin Ruger nogo use him left eye see for this country sef?
If this country was a youtube channel, the drama nogo ever end. How e wan take end na?
E go be like one of those party wey no dey end. You know that kain party wey Tuface sing about.
E come be like say this week vayolence spray perfume go market. Or how do you explain what is happening between Victony, Ruger and Buju–or bxnx–or whatever pronunciation is given to the bunch of consonants he woke up one day, put together and said it’s his new name.
While the rest of us were busy trying to make our daily 2k, Ruger woke up, took his bath, wore his garments, sprayed perfume, and then came online to tell the world that he’s better than Buju.
Wait a minute. Hol’ am there fess. Why Ruger dey always cover one of him eye sef? Oh, you sef no know. Someone said he’s practising blindness for the future. No be me talk am sha.
Before we go far, it’s worth mentioning that Buju himself isn’t a saint either. Before he ‘blew’ he was in the habit of tweeting condescendingly unbelievable things about other musicians. By the time he became famous, twitter FBIs did their job and baba had to come out to begin apologising for his sins of yesteryears.
As we dey try settle the Ruger matter, naim Omah Lay come enter o.
From where to where na? Grandpa Omah Lay eku ise o. Ahn ahn, you didn’t tell us na. All those girls wey dey dance dey try touch you for concert, na dobale all of them suppose dey dobale na.
Abeg no vex bros. Na we no know.
But wait o. Na so Victony sef take collect.
But Victony get mind sha. You get accident, God save you, you come dey try walk small small, instead make you dey ascribe all power to the Almighty, all you could think of na the voluptuous well-rounded ikebe of the well-endowed daughter of Eve.
How him wan take heal complete na?
Baba even do song dedicate to ikebe sef.
Comrade no be soo o. Wetin dey sweet dey kill o. Thick thighs may save lives–but they also suffocate o. No let the fair daughters of Eve carry you trabaye.
As we dey even talk that one, naim Portable go Osun to campaign for him candidate go off paynt for street.
You know say them don talk am say the guy dey smoke too much igbo, and say e suppose spend christmas for rehab.
If there’s one human being on this earth who you should never commit any crime with, na Portable.
Baba legit took to social media to tell the world that he has been paid to support Tinubu and that that’s what he will do.
Like who does that?
Apparently he is supporting Oyetola and Davido is also going all out for his uncle, Ademola Adeleke and is on ground in Osun.
Na so them clash o. Davido sharply unfollow am, naim my guy just dey wail.
Anyway, all that one no concern me. Weekend don reach. Na to go relax remain, only say my bank account dey warn me